Ghana scientists discover new variant of Covid-19 after genomic sequencing show say de virus enter de country.

President Akufo-Addo reveal say dem find de new strain inside passengers who arrive for de aiport.

“Recent genomic sequencing wey wana scientists do de prove say some passengers who arrive test positive for de new COVID-19 variant” President Akufo-Addo reveal.

Ghana health officials isolate de infected passengers but dem start dey do contact tracing among de general population sake of some of dem attend parties, weddings, funerals den tins wey dem no observe Covid-19 safety protocols.

Coivd-19 cases for Ghana start dey see sharp increase as health officials dey record 200 cases daily.

According to Prez Akufo-Addo, de number of patients who dey ICU rise from 18 to 120 who dey inside critical condition.

Number of active Covid-19 cases for Ghana be 1,924, out of which de deaths increase catch 352 wey 33 patients dey inside critical condition.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *